Money Fight Loading: Eniola Badmus calls out Funke Akindele for celebrity Boxing

 
Popular Nollywood actress Eniola Badmus don challenge fellow actress Funke Akindele to enter boxing ring for celebrity fight.

This one come shortly after Nigerian content creator Carter Efe beat singer Portable for celebrity boxing match wey happen on Friday.

Carter Efe carry go home N50 million after him win. To celebrate am, businessman E-Money still bless am with extra cash gift.

Before the fight, music executive Soso Soberekon don already give both Carter Efe and Portable N40 million each to support the match.

After seeing how the fight go, Eniola Badmus come drop viral post for her Instagram, dey call out Funke Akindele make dem settle their own for ring.

According to her, she say: “Funke Akindele, make we enter boxing ring. Time don reach. Soso, E-Money, make una sponsor am. No time… money must be made.”

Now fans don dey react as many dey wonder if this celebrity fight go really happen 👀

0/Post a Comment/Comments

Peoplesmind.com.ng