Lady regret leaving ex-boyfriend

Lady regret leaving ex-boyfriend, she wrote 👇
“If I know say na like this life go be I for just dey with that one boy I was dating in 2018 because since I left that boy na so so súffer I dey sûffer. 

I don't know if he sweár for me o but he no suppose sweár for me because I left him because he no get money.

Honestly, I was thinking other boys are better, that's how I left him. This boy can have only N5k make he give me N4,500 inside. 

See all those people were dey set camera dey tell you make you leave less, the time go reach you no go even see the lesser sef because if to say I know, I for just dey with this boy, don build with am. 

E sure me say we for don make am and now like this e don dey be like things don dey better for the boy. I no even know wetin I wan talk sef. 

I for just dey with him since 2018, I have just been sûffering up and down. 

You people wey dey advice person say anything you want dey outside, e no dey oh! Things wey we want e fit be say na our imagination e dey, e no really dey at all” .

0/Post a Comment/Comments

Peoplesmind.com.ng