“You Guys Are So Lucky” — Lady Breaks Down Over Lack of Parental Support While Studying Medicine



Her words
Since I was born I never see person wey buy me slippers before o, say na uncle, aunty, brother, papa, mama, I never see o. 

Una dey get luck for this life o. Some of you ehhn, una no even know wetin God do for una. You guys are so lucky, like, your dad saw you growing up abi your mom is alive, you no know wetin God do for you and they are supporting you. 

Me I no even see. I'm in a group someone said my mom paid my school fees, others too, my mom did this, did that. I say me, where the mom dey? E dey gr@ve? Who I wan call? My papa no get.My school fees is above N400k, a medical student yet I'm still running around doing business. You guys are very lucky o. I envy you people”

0/Post a Comment/Comments

Peoplesmind.com.ng