Lady criticize role of churches in the country, claiming that religious institutions only benefit pastors and their families

"Church no benefit me anything. Nobody wey church benefit for this Nigeria. Make I tell you the only people wey church benefit for this Nigeria. You see pastors, their wives, their children, reverend fathers and their families, na them church dey benefit.

Church no benefit me anything. Somebody come my comment section dey say 'if I like make I go church, if I like make I no go, na me lose'. Aunty wetin I lose? Abi na me dey go church go keep money, dey give money wey I suppose take buy children garri.

Ever since them born me na me dey carry money go dey give for church give money. As Nigeria dey so, na church keep am if not Africa.

Church no dey Nigeria. Na oyibo wey carry am come na dem carry am go back. Na tradition dey now. No be when person comes Church e go drop money, na so dem dey do am for traditional too.

Na church dey keep Nigeria hungry. If you think it's a lie, go check all the church accounts see the money wey dey there. Na him make all the men in Nigeria dey do everything possible to open church..."

0/Post a Comment/Comments

Peoplesmind.com.ng
Contact (+234)9158716347 for more information